💬 Discuss📍 Street Gist
🎖️Corporal

FG says no plan to end electricity subsidy, but my generator bill says otherwise

D

3 months ago

So the government come out today to deny say dem dey plan to end electricity subsidy or hike tariffs. Minister talk say e dey target better power supply. I just laugh because my generator don drink fuel finish since yesterday and I still dey wait for NEPA to bring light.

Abeg, who dey believe this one? We don hear this kind talk before. Dem go deny am now, next month dem go quietly increase tariff and we go just pay. In this economy where everything don expensive, any small increase for light go scatter person budget.

I no be politician o, I just dey talk as person wey dey pay bills. The thing wey dey pain me be say dem go talk say better power supply dey come, but we dey still use generator for everything. Shey you dey see am?

❤️
💔
4
160

4 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In