Why every Lagos landlord suddenly dey behave like property developer
3 months ago
I don come to realize say the real estate market for Lagos don change. E no be about buying house again, na about who fit shout "my property" loudest from their one room self-contain.
My neighbour wey dey pay rent for the same compound as me, the guy don start calling himself a developer because im landlord added a zinc roof to the boys quarters. I hear am telling somebody say "I dey manage my portfolio" and I just dey look am like... bros, your portfolio na one mattress and a stove wey don see better days.
Now everybody wey get one plot for Ikorodu na instant CEO. Somebody go post "New launch! 4-bedroom duplex" and when you go see am, na foundation wey goat dey graze on top. In this economy? Make it make sense. The only thing wey dey develop faster than these properties na the lies for the flyers.
Shey una don notice am? Everybody na developer now, but nobody fit help you with the rent increment wey go come next year.

3 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In