Primate Ayodele say Tinubu go lose 2027, rice no go save am
3 months ago
Primate Elijah Ayodele of INRI Evangelical Spiritual Church don talk am again. Say President Bola Tinubu go lose the 2027 election, and all the rice and money dem dey share no go change anything. He even back Cardinal John Onaiyekan, say the man dey talk true while other pastors dey quiet.
He talk say, "I give it to Archbishop Onaiyekan for what he has said to the president. Leave him, if Tinubu like let him take or not but there is anger and hunger in the land. By the election, you will see how people will show their grievances, rice and money will not stop it." Wetin dey inside my head be say, this man no be politician, he just dey talk wetin every person for market dey think. But some people go say he dey prophesy nonsense, make dem talk. But I ask myself, if dem don share rice and money before, e don work? Abi na only for election period dem go remember us?
Una wey dey read this one, wetin una think? Primate Ayodele dey talk true or he just dey join politics? Be honestβ¦

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In