💬 Discuss🏢 Oga Wahala
🎖️CorporalMy apprentice don buy car, my own pikin dey beg for bus fare
M
3 months ago
Na so I dey laugh this morning. My apprentice, the one wey I train from zero, just buy himself used Toyota. I see am park for front of my stall, he dey shine teeth like he don win lottery.
Meanwhile my own son wey dey NYSC dey call me say he need transport money. Chai! Life no balance at all.
But I no vex. Na so market dey. The boy hustle pass my son. My son dey wait for white collar job, the apprentice dey wake 4am everyday. Who born you? Hard work no dey kill.
❤️
💔
1
188
1 Comment
Sign in to join the discussion
Sign In