💬 Discuss📍 Street Gist
🎖️Corporal

Wizkid vs Davido: I swear Davido carries the culture on his back and una no ready to talk

E

3 months ago

My guys, na so I dey scroll through the timeline and see the usual Wizkid vs Davido arguments. I swear, the way some of una dey defend Wizkid like he personally dey pay your school fees, e be like say una no see the work Davido don do for this music industry.

Abeg make una hear me out. Davido dey everywhere, e dey carry the culture enter every corner of this country. From the streets to the villages, na Davido music wey dey play. And the man no dey tire, e dey drop hit after hit, e dey feature new artists, e dey give back to the youth. Wizkid fine, e get style, but e dey do like say na only him sabi music. Who send him?

I no say Wizkid no get talent, but Davido na the people's champion. Which one you dey side? The one wey dey show up or the one wey dey disappear?

❤️
💔
2
178

2 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In