Sowore tell Tinubu make dem first arrest Atiku before im apologise
3 months ago
Omoyele Sowore don finally speak on the matter and e no carry last. The AAC presidential candidate tell journalists for Abuja today say im no go ever apologise to President Tinubu for calling am criminal. Instead, e say make dem first go arrest Atiku Abubakar wey call Tinubu forger and drug baron yesterday. E say, "They say my crime is that I called him a criminal, Atiku called him a forger and a drug baron yesterday. Let them go and carry Atiku."
This one na pure comedy for our politics. Sowore even add say na Tinubu suppose dey apologise to Nigerians for presenting himself for office wey e no qualify for. So the question be, if dem arrest Atiku first, Sowore go still talk? Or this one na just election drama wey go end up nowhere?

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In