🎖️Corporal

Peller dey lie say he poor? The boy wey dey pay for stolen phones dey talk say he no get money?

T

3 months ago

So Peller don come out again, this time e dey talk say he be poor boy from Ikorodu. Na so? The same boy wey talk say he paid for stolen phones for im wedding, now e dey form broke? Make I laugh small.

I no get problem with humility but this one don reach level of cringe. If you get money, just dey enjoy yourself. No need to lie say you dey suffer when the evidence dey everywhere. E dey make me wonder, na who these celebrities think dem dey fool?

Anyway, na im life. But the question wey dey my mind be say, if Peller no get money, then who buy those phones wey im talk say im pay for? Abeg make una help me ask am.

❤️
💔
3
163

3 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In