Uzodimma and Umahi don't speak for Igbo, that's the truth
3 months ago
Igbo Community Association FCT just release statement today, and dem say Uzodimma, Umahi and Nwebonyi no be spokesperson for Igbo people. Ikenna Ellis-Ezenekwe talk am well, he say the claim say Tinubu go sweep all five South-East states in 2027 is completely detached from reality on ground. He even quote say, "The South-East considers the Tinubu administration a failed administration and, for this reason, will not vote for Tinubu."
This one na pure economics. Na we wey dey market see am first. Food prices no dey come down, naira still dey suffer, and these politicians dey talk say we support the man wey dey cause am? Abeg. Uzodimma and Umahi dey fight for their own political survival, not for Igbo interest. Dem go collect appointment, dem go talk anyhow. But grassroots people no dumb. We sabi who dey chop our money.
Any Igbo person wey go vote for Tinubu in 2027, make dem explain to us how market don better for dem since 2023. Be honestβ¦

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In