🎖️Corporal

Woman die two weeks after born pikin. Wetin dey happen to una ooo

I just see news about Coach Lara Don-Momoh wey die two weeks after she born her first pikin. Ah ah! Na so life dey do person?

She carry belle for nine months, suffer, born. Then two weeks later she don go. The pikin wey she born, e go grow up without im mama. That one go pain am for life.

Na why I dey tell my own pikin sey, no matter wetin dey worry you, make you still dey check your health. We women dey carry too much for head. If your body dey talk to you, listen. No be every sickness na malaria. Wetin una think about this one?

❤️
💔
2
186

2 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In