⚡ Break Story📍 Street Gist
🎖️Corporal

NRS crypto tax guidelines are here, and my head don scatter

D

3 months ago

See ehn, I just dey read this new NRS guideline on virtual assets taxation and my head don scatter. Dem say if you dey trade crypto, you go pay tax on gains. But which gains? In this economy wey Bitcoin dey fall like rain, my portfolio just dey cry every day. I no even get profit to eat, not to talk of paying tax.

The thing wey dey worry me be say, how dem go take track am? If I dey use peer to peer, na cash to cash, no paper. Dem go come dey ask for transaction records wey I no even get. And the rate, na 10% on gains? Abeg, make I just keep my mouth shut. But seriously, if you be crypto person for Nigeria, you need to start keeping records. No be joke.

Na only God know how this one go end. Una wey dey trade, wetin una think about this tax wey dem don bring?

❤️
💔
5
179

5 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In