Wike say only Tinubu fit win Rivers for 2027, make we talk
3 months ago
Nyesom Wike don talk again. For im monthly media chat for Abuja today, the FCT Minister say anybody wey dey count Rivers State for 2027 election should just cancel am, because na only President Bola Ahmed Tinubu fit win that state. He say, "If anybody is counting Rivers, go now and cancel it. The only person that can count Rivers is Asiwaju Bola Ahmed Tinubu. I'm not talking because I want to talk; I'm talking as a political realist because I know my people."
Wike say politicians from PDP, APC, Labour Party, AA and other parties don form one big coalition to support Tinubu for 2027. He say na for the interest of Rivers State, make dem support the candidate wey dey most acceptable, not as APC or PDP but as coalition candidate. He even talk say, "All we are doing is for one purpose, to support President Bola Ahmed Tinubu. It is all-inclusive and it is spreading like wildfire."
Na so so talk. But wetin dey sweet me for this one na how Wike dey always claim say na im know Rivers people. He say nobody fit teach am politics because he don dey since 1999. But na we for North know say when one man hold power too long, e begin think say e be god. Rivers people, wetin una think? Wike say na only Tinubu fit win una state, but una get mouth to talk. Be honest, una go accept this one?

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In