N1.08 trillion for cooperative college? Atiku dey talk true

S
Steel Gorilla from Onitsha

3 months ago

Atiku Abubakar don open eyes for Nigerians about this 2026 budget wey Tinubu dey hide behind. Tracka reveal say Federal Cooperative College, Oji River for Enugu get N1.08 trillion to carry out 2,791 projects across 36 states and FCT. Na cooperative college wey suppose dey teach people how to save money, now e dey build roads, dialysis centres, solar streetlights, markets, everything. Atiku say this one na blueprint to defraud Nigerians, and I agree with am.

Atiku talk say, "Nothing exposes the hollowness of that claim more than a budget that turns a federal cooperative college into one of Nigeria's largest project-implementing agencies." E also ask who nominate these projects, who approve dem, who go supervise dem, who go accountable. This government dey tell us say no money, dem remove fuel subsidy, dem raise tax, dem borrow plenty, but dem fit hide N1.08 trillion under one college? Na serious fraud. If this one no make you vex, then wetin go make you vex?

❤️
💔
0
198

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In