Uba Sani says 2027 election don finish, North go give Tinubu 95% votes
3 months ago
Kaduna State Governor Uba Sani don declare say the 2027 presidential election already concluded, and the North go give President Tinubu at least 95% of the total votes. He talk this during the flag off of the 122km Kaduna-Birni Gwari road on Tuesday. The man say Kaduna people dey happy with Tinubu, and he even challenge anybody to dispute am.
E talk say, "We have to be happy with what he has done for us and whether we like it or not, Kaduna is the capital of Northern Nigeria, everyone is proud of Kaduna." He also add say no past president don do wetin Tinubu don do for Northern Nigeria. Meanwhile, the same Tinubu wey dey struggle with banditry, inflation, and fuel prices wey don pass 900 naira per litre for some places. Abi na road wey go finish in 2027 wey go make us vote am?
This kind talk from a governor wey suppose know the suffering of common man for Kaduna, e dey funny. The North get memory, dem no forget how dem suffer under this administration. So I beg una, una believe say election don conclude, or na just political talk wey go scatter when time reach? Let's argue thisβ¦

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In