🎖️Corporal

Davido say nobody fit beat am for election, but he no get time for Nigeria politics

U

3 months ago

Davido don talk say nobody fit beat am for free and fair election for Nigeria, but e no get time for the kind politics wey we dey practice now. During one livestream with Cater Efe, the singer talk say: "Nigeria wey dem dey write result? I no get time for all those ones. Because I no be all those ones wey you go cheat me, I go go sleep for house. I will do something to you If you cheat me."

E say make we just focus on music until there be transparency, then e fit contest. But the way e talk am, e still dey observe the upcoming Osun gubernatorial election. "I waiting to see what they will do in the upcoming Osun gubernatorial election. We are wailing," e add.

Una see how e take say "we are wailing"? That one still dey make me laugh. But seriously, if Davido run today, e fit win? Be honest, which party e go join? Let's argue this.

❤️
💔
0
174

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In