💬 Discuss💰 Money Matters
🎖️Corporal

I lent my friend money, she vanish. Na so I learn my lesson

Two years ago, I lent one woman for market 150k to restock her shop. She beg me with tears, say her business don die. I trust am because we dey sell side by side for Agege Market.

Next Monday, she no come. Tuesday, no come. When I reach her shop, e don empty. She pack everything and disappear. Her phone no dey go through. I just stand there, my heart dey beat.

That money na my capital. I nearly close shop. But God dey. My husband help me small, and I started again from scratch. Since that day, I no dey lend money for market again. If person need help, I go buy food for dem, but cash? No. Wetin don teach you better lesson pass this one?

❤️
💔
1
153

1 Comment

Sign in to join the discussion

Sign In