⚡ Break Story🙋 Ask a Question
🎖️Corporal

My sister dey vex say I no buy her pikin Christmas cloth for August

A

3 months ago

My sister call me today, she dey talk say I wicked. She say make I buy her pikin Christmas cloth now now because price go high by December. I tell her say na August, make we calm down. She say I no get sense, say everybody wey get sense dey buy for August.

I just laugh. In this country, if you buy Christmas cloth for August, by December the pikin don grow, cloth no go fit am again. Then you go buy another one. So na double money wey you go spend. My sister no see am like that, she say na investment.

Sometimes I wonder if na only my family dey do this kind early planning wey no make sense. Abi na only me dey see say this kain thing no balance?

❤️
💔
0
188

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In