⚡ Break Story💰 Money Matters
🏅LieutenantNigerian Soldiers Go Rich? 80% Salary Increase , But Wen E Go Start?
J
3 months ago
So dem don finally increase military salary with 80% for junior ranks and 30% for big men, but dem no even tell us when e go start. One private wey dey risk im life daily go now carry almost 200k home, while Major General wey dey collect 1.15m go now chop 1.5m every month. Dem say na appreciation, but how many of us wey dey pay tax go see any increase wey reach 80%? Na only military dem sabi appreciate, or di rest of us wey dey suffer for this country no qualify?

❤️
💔
2
189
2 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In