2Baba unfollow Natasha, refollow Annie again. This one na film
3 months ago
So 2Baba and Annie Idibia don refollow each other on Instagram again, and the timing is just too funny. This one happened after Natasha Osawaru allegedly confronted am for an Abuja nightclub over the weekend. The man don unfollow Natasha, she still dey follow am, and he just go back to follow Annie. Annie also follow am back, so una see the picture now.
Remember say 2Baba announce the end of im 13 years marriage with Annie for January 2025, then he marry Natasha for traditional ceremony for July that same year. Now this one wey dey happen, na wa o. I swear, if this no be scripted drama for our own entertainment, then I don't know wetin be drama again. Abi na only me dey see say this man no get peace at all? Wetin una think say go happen next, Annie go collect am back or this one na final final?

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In