💬 Discuss🌟 Celebrity Gist
🎖️Corporal2Baba and Annie refollowing each other? Wetin dey happen for that house?
C
3 months ago
Na wa o. So 2Baba and Annie don refollow each other on Instagram again. Una see am? One minute dem no dey follow, next minute dem dey follow. This one na proper yoyo.
Person wey get wife and side chic dey play this kind game. Annie don suffer for that marriage. She don born pikin, she don dey support am, and now na so so wahala. If 2Baba no gree make peace with Annie, na hin own loss. But see, we no know wetin dey happen inside that house. Na only God know the truth.
Una wey dey follow this matter, wetin una think? Dem go settle or na more drama dey come?

❤️
💔
0
176
0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In