🎖️Corporal

This Kiddwaya talk sef, see rubbish wey rich man go talk

M

3 months ago

I just see wetin Kiddwaya talk about colonisation. Say Nigeria for develop more if dem colonise us longer. My hand dey itch o.

This boy don chop life wey im papa money buy. Im never suffer for this country one day. If im try sell tomato for Mile 12 market for one week, im go know say we no need any white man to teach us how to hustle. We don dey survive before dem come, we still dey survive after dem go.

Na money dey talk, not sense. If im poor like us, im for talk different thing. Una wey get money, una no fit just dey talk anyhow? 🙄

❤️
💔
2
187

2 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In