🎖️Corporal

Why I No Dey Trust Any Man Wey Dey Do 'Soft Life' For Insta Story 💔

My people, I just dey look how 2baba and Natasha matter don take over everywhere. But e make me remember something. All these men wey dey post 'soft life' for Insta story, dem dey hide something. Na so my own husband dey do before I catch am.

I no say women dey perfect o. But na man wey dey too show off for social media wey I no trust. E dey do am for who? For strangers? While im wife dey at home dey manage fuel price and school fees? I reject it!

If your man dey post everything for Insta, shey you dey suspect am? Or na me only dey see am? 🤔

❤️
💔
0
184

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In