🤫 Confess🙋 Ask a Question
2Baba and Natasha story just show say marriage no be beans o
G
Giant Tortoise from Awka
3 months ago
My sister don send me this 2Baba and Natasha video tire since weekend. I no even fit watch am finish, e dey pain me inside. See man wey don sing for us since forever, now im own house dey scatter for public.
Na so we dey see am for market every day. Woman go dey cry say her husband don carry everything go meet side chick, man go dey talk say im wife no dey respect am. Both of dem dey shout, but na the children go suffer.
I just dey ask myself, who e dey help when una dey drag dirty linen for social media? Nobody. God for give us wisdom for our own marriages.

❤️
💔
2
152
2 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In