⚡ Break Story🎓 School Matters
🎖️CorporalASUU don set timer for 20 universities , 14 days to pay up or school go shut down again.
C
3 months ago
Na the same agreement wey dem sign for 2025, but government still dey drag feet with subvention and state governors dey behave like the matter no concern dem. How many times we go repeat this circle of ultimatum, strike, negotiation, and small small token wey go make lecturers return only to start again next year?If ASUU strike again, na students wey go suffer pass , but if dem no strike, the system go continue to crumble. Which one you dey support: lecturers wey dey demand better condition, or government wey dey pretend say education matter?

❤️
💔
5
198
5 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In