💬 Discuss⛪ Church Gist

Sheikh Jingir don expose wetin northern Christians dey talk for years

F
Fierce Eagle from Lagos

3 months ago

Na only yesterday Rev. Joseph John Hayab, the chairman of Northern Christian Association, come out on Channels TV and say the statement wey Sheikh Sani Yahaya Jingir make about Muslim-Muslim ticket don finally expose wetin Christians for north don dey complain about for decades. The man say the preacher call Christians "infidels" for Kano, and na the governors of Kano and Jigawa states dey there, dem just dey cheer am instead of rebuking am.

Hayab talk say "There is always a day when you will no longer pretend. We have been living in pretence in Nigeria, lying to ourselves that we are together, lying to each other that there is unity and lying to each other that we are co-citizens." That one pain me because na true. We too dey pretend for this country, we dey hide the real tins wey dey happen. If na so dem dey talk about us openly for public, wetin dem dey do for secret?

I no be politician, but I know say the Muslim-Muslim ticket no win election by Muslim votes alone. Christian states still vote for Tinubu and Shettima. So when una say make we no apologise because una get numbers, na wetin? We dey together for this country or una just dey use us when una need us? Be honest, una wey dey support this kind talk, una think say na correct way to treat fellow Nigerians?

❤️
💔
3
165

3 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In