Peter Obi say professors dey help illiterates rig election, una fit argue am?
3 months ago
Peter Obi don talk again for Bauchi at the Goodluck Jonathan Foundation Democracy Dialogue. The man say Nigerian professors now dey aid illiterates to rig election. He say, "Nigerian professors now aid election rigging in Nigeria. I was in court for three years challenging my election, five judges that I never met for one day gave judgment in my favour, it cannot happen in Nigeria of today."
He talk say lawmakers don remove forgery from electoral offences, Senior Advocates dey defend forgery, religious leaders dey pray for criminals, and judges dey sing on your mandate. This man dey see the whole system wey don spoil. But people go say he dey bitter because he no win. Abi wetin una think? If professors wey suppose be the wise ones dey help rig election, then who go save this country?

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In