Fuel price drop: don't celebrate yet, here is the real gist
3 months ago
My brother, I just see the news say filling stations don reduce fuel price again. My first reaction na to check if my generator don finish fuel or not. This kain news sweet but make we no carry our hand dey dance too early.
I remember when I was a young lawyer, fuel price used to be stable. Now, every month get new price. The thing wey dey pain me na say when price drop, transport fare no drop. When e rise, na immediate increase. The law of supply and demand no dey apply for Lagos roads.
Anyway, I no be economist. I just know say my pocket go still feel am. But abeg, if you see transport fare don drop for your area, make you tell me. I wan know if this one na real change or just another temporary thing.
5 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In