💬 Discuss📍 Street Gist
🔰Sergeant

Davido vs Israel DMW: Oga dey mad, but the boy get point?

C

3 months ago

Just watched the video of Davido scolding Israel DMW for arguing with him. My guy said 'Don't ever argue with me' and I felt that authority energy. But hold on, Israel be grown man wey dey manage the man's affairs. Abeg, if your oga dey wrong, you no fit talk?

This is the same way my uncle dey talk to his driver like he no be human being. Oga is oga, but respect should be two-way. Even the Bible say 'iron sharpeneth iron'. If Davido no gree hear word, e go continue to dey make mistakes. But e be say na him money dey talk, so who I be? 😭

Una wey get boss wey dey always shout, how una dey manage am? Shey una dey talk back or una just dey nod and collect salary?

❤️
💔
0
183

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In