Sheikh Jingir don talk am again, no regret for Muslim-Muslim ticket
3 months ago
Sheikh Sani Yahaya Jingir wey be leader of Izala Scholars Council don come out again to talk say he no get any regret for the Muslim-Muslim ticket statement wey he make. The man tell BBC say he go continue to support and encourage Muslims to back Muslim-Muslim ticket, no matter wetin anybody talk. He even say, "I have no regrets. I will continue to support and encourage the Muslim-Muslim ticket. What they say will not stop me. They started it; at a point, we suffered in their hands."
Na during the mass wedding wey Kano State Government arrange for 1,500 couples he first declare this support. And now he dey challenge anybody wey think say Christians or other religious groups pass Muslims for population. This man sef, he dey talk as if na only Muslims dey Nigeria. But e be like say he don forget say we all dey suffer together for this country.
Person wey dey call Christians infidels for public, na im be pastor or imam? Abeg, make una tell me, if na your religion dem dey insult like this, you go just dey quiet? Be honestβ¦

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In