Davido say INEC REC from Ebonyi dey Osun to rig election, we go resist
3 months ago
Davido don raise alarm say the INEC REC from Ebonyi State, Pauline Ugoyenka, don land for Osun State before tomorrow's governorship election. She no be Osun REC, she no get any business there. Davido post on X say, "She was not deployed by INEC. What is she doing in Osun. She was sent here from Governor Hope Uzodimma to rig. We will resist you, madam."
Make we talk true. This one na pure power play. Governor Hope Uzodimma from Imo sending REC to another state? INEC no even release any statement. Meanwhile Ademola Adeleke wey be Davido uncle dey run for second term, and APC, ADC candidates dey eye the seat. If dem fit send REC from Ebonyi to Osun, wetin go stop dem from doing worse on election day? Una wey dey Osun, open your eyes wella. Election na tomorrow, August 15. Which side you dey?

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In