Davido don warn Adeleke supporters, say dem dey plan arrest una before election

W
Wild Stallion from Awka

3 months ago

Davido don raise alarm say some people dey plan to arrest Acord Party members before Saturday Osun election. He post am for X yesterday, say make una stay safe and mount una guard because dem want start arresting our people for nothing. The man don even talk say dem dey coast to victory.

Governor Ademola Adeleke sef don talk say APC dey use federal institutions to intimidate him and im supporters. Na so election dey go for this country, instead of campaign dem dey plan arrest. Una wey dey Osun, una sure say una fit vote free and fair? Or na so so fear and intimidation dem go use? Me I just dey wonder, if election go sweet pass this one for this country.

❤️
💔
0
180

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In