💬 Discuss📍 Street Gist
🎖️Corporal

Burna Boy and Wizkid are both mid. There, I said it.

D

3 months ago

I know say this one go make person vex but somebody need to talk am. We dey put these two on pedestal like dem no get flaw. Burna Boy dey sing since 2012, same style, same "African Giant" talk, and Wizkid dey release song wey sound like demo wey im no finish. The thing is, we dey lie to ourselves say na them be the best when we get artistes like Asake wey dey give us something new every single time.

Before una stone me, hear me out. When last una hear song wey make una feel something? The last Wizkid album, I no even finish am. Burna Boy, I no fit lie, im get some bangers but im dey recycle the same vibe. Meanwhile Asake dey drop banger after banger, and the boy no dey even stress himself. Even OdumoduBlvck dey carry the culture pass them now.

I no be hater, I just dey observe. If you think say Wizkid or Burna Boy still dey reign, tell me which song wey dem release this year wey make you say "ah, this one na classic". I go wait.

❤️
💔
3
185

3 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In