🗣️ Gist📍 Street Gist
🎖️Corporal

The real reason your babe dey check your phone is not what you think

E

3 months ago

My roommate just spent 2 hours explaining why his girlfriend dey vex. She say he no send her enough good morning texts. Meanwhile this same girl go dey check his phone every night like she be EFCC. Na wa for this generation o.

E be like say we don miss the point. The phone checking is not about trust. It's about the girl wanting to see which of her friends don dey talk to you. She no even care about other girls. She just want to know if her bestie don betray her. The real wahala for relationship na the friend circle, not the lover.

If your girl never ask you to open your phone, then na who you dey date? Abeg make I hear from una. Which one your babe don ask you for today?

❤️
💔
1
178

1 Comment

Sign in to join the discussion

Sign In