Dino Melaye say Damagum, Anyanwu, Bature sell PDP to Tinubu
3 months ago
Dino Melaye don open yash for PDP, say three former officials sell the party to President Tinubu. He talk am for Kaa Truths podcast, say the former acting National Chairman Umar Damagum, former National Secretary Samuel Anyanwu, and former Organising Secretary Umar Bature all sell out. According to am, “Damagun, Anyanwu and Bature sold out the PDP to the president before Wike finally organised the burial of the party.”
So the party wey suppose be opposition don die before Wike arrange the final funeral. Na so dem dey play us for this country. Instead of PDP to stand strong and check APC, them dey inside bus stop dema own party. Make una ask una self, if the opposition don collect bribe, who go hold government accountable? Una go still vote for them next election?

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In