🗣️ Gist📍 Street Gist
🎖️Corporal

Man U fan for life but this season na pure shege

C

3 months ago

Another weekend, another match wey I go watch with heart for my hand. Man United don scatter my emotions since I start supporting dem from PH. My friends wey dey support Arsenal and City dey laugh me but loyalty na loyalty.

I still dey pay for viewing centre every weekend. Na so we see am. But e no go stop me. When we win, na sweet pass any woman wey sweet. When we lose, I just go house and call my mama for Sunday.

Who get team wey dey suffer dem like this? 😤

❤️
💔
13
168

13 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In