🗣️ Gist📍 Street Gist
🎖️CorporalSingle mothers dey happy pass married women? Iyabo talk true talk
C
3 months ago
Just dey scroll and I see wetin Iyabo Ojo talk about single mothers dey happier than married women. I no go lie, e make me think.
Na so many of my boys dey suffer for marriage. One friend of mine, im wife dey control am like child. No money for hand, no freedom, and e still dey smile for pictures. Meanwhile my sister wey get two pikin, she dey hustle, she dey manage, but she get peace of mind.
Marriage na good thing o, but na who you marry. Single mother dey suffer but she no dey explain to anybody. She dey wake up, she dey hustle, she dey feed her pikin. No wahala of who go call am. Which one better? I no know o. But I dey observe.
❤️
💔
5
195
5 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In