Akpabio don stop Osun collation? Davido just drop this one
3 months ago
Davido don open mouth finish. The Afrobeats star just post on X say Senate President Godswill Akpabio call the collation centre and order them to stop collating Osun governorship election results. He wrote, "Senate President Akpabio has called the Collation Centre that they should stop collation." This one na serious allegation o.
INEC don already upload over 80% of results on their IReV portal, and Davido's uncle, Governor Ademola Adeleke, don win some polling units already. So why dem go stop collation now? Abi dem don see say APC dey lose and dem wan change the game? This Osun election wey suppose be straightforward, dem dey turn am to another wahala. Una think say Akpabio get the power to just stop INEC from doing their work like that?

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In