⚡ Break Story🚨 Crime Watch
🏅Lieutenant

14 Kidnappers, N30.5m Ransom: Is Enugu Police Truly Winning or Just Counting?

Z

3 months ago

Na so police go arrest suspects, recover money, and we suppose just clap? But the real question wey dey prick my mind: if kidnapping business dey pay this well , N30.5m plus $98,700 from just a few victims , how many more syndicates still dey operate wey police never catch? Dem say dem arrest 14 people, but na only three victims dem rescue. So the remaining victims wey don pay ransom, dem no dey matter? We fit trust this victory when the same gangs just relocate to Port Harcourt and continue their work?Abeg, make una talk , na real progress this one be, or na just another parade wey go make us feel safe until the next abduction?
❤️
💔
0
162

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In