πŸ”°Sergeant

Dino Melaye don finish APC with one tweet, 34 governors no fit save dem

O

3 months ago

Dino Melaye don finish APC with one tweet this morning after Osun election. INEC declare Governor Ademola Adeleke of Accord Party winner on Sunday and Melaye no waste time to mock the ruling party. He talk say despite having President Bola Tinubu, 33 state governors and Senate President, APC still lose.

He write on X, "Till we meet again APC. Rest in Peace. 34 Governors, Senate President and Tinubu defeated. Odabo Tinubu… Ancestral State lost." This one heavy o. When one party get all this federal power and still dey lose state election, something dey wrong. Na only God know wetin dey happen for that party headquarters.

Osun people don show say no amount of federal might fit force them. Make una tell me, if APC fit lose Osun with all these heavyweights, wetin go happen for 2027?

❀️
πŸ’”
0
173

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In