🗣️ Gist📍 Street Gist
🎖️Corporal

Nigerian mums and the 'small small' food portion that never ends

C

3 months ago

My mother go call me say "Chidi, come eat small small." Small small my foot. By the time I finish, I don eat enough to feed Rivers United starting 11. 😤

Then she go say "You no chop well, you don grow thin." Me wey I dey roll like football. I swear, na only Nigerian mothers get this power. Dem go give you food wey fit last one week, then still ask if you hungry.

If you try to run, she go chase you with the pot. Na so we see am. 😂

❤️
💔
6
165

6 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In