Davido drags INEC REC again, says her mission go fail for Osun
3 months ago
Davido no gree rest for INEC o. The singer don fire another shot at Mrs Pauline Ugonyeka, the Ebonyi State REC wey don stay Osun since before the election. Friday he posted on his verified X handle say, "Mrs Pauline Ugonyeka, I heard you're still in Osun, your mission tomorrow will fail as the INEC REC. Osun people will stand by their votes."
This one na because Ugonyeka supposedly no be Osun REC but she still dey there for the governorship election wey hold Saturday. Davido uncle, Ademola Adeleke, na the incumbent governor wey dey seek re-election, so you know say the matter na family matter for am.
Election don pass now, but the gist still hot. Una think say REC wey no be assigned to Osun get any business there? Abi na normal INEC style wey dem dey use scatter votes?

1 Comment
Sign in to join the discussion
Sign In