💬 Discuss📍 Street Gist
🎖️Corporal

Boli vs Suya: Which One Dey Sweet Pass For Saturday Night?

K

3 months ago

Weekend don pass but the debate still dey hot for my head. Some people dey swear by boli and groundnut, others say suya with extra pepper na the real deal. Me, I don think am well well and I don land on one side: BOLI WINS IT. No be small thing.

See, suya dey sweet but e dey finish your pocket fast fast. One stick no full stomach, you go buy two, three, before you know say you don spend money wey suppose buy recharge card. Boli na different level. One big plantain, roasted well, e go full you. Add groundnut, e go even full you more. And the price? Make I break am down for you. Boli na 500 naira. Suya wey go satisfy you na 1500 and above. Profit margin clear.

Plus, boli no dey give you the wahala wey suya dey give. Suya go make you drink water like person wey just cross Sahara. Boli dey calm, e dey sweet, e no dey rush you. My people, wetin dey your own side? Boli or suya? No dey lie.

❤️
💔
0
160

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In