🤫 Confess📍 Street Gist

I caught my wife's pastor doing something I can't even type

O
Ocean Shark from Ilorin

3 months ago

Last month I come home early from work, I no even reach my gate when I see our pastor, Pastor Ade, dey come out from my compound. He see me, he just nod small and enter his car, e no even wait to greet me.

I enter house, my wife dey inside, she dey arrange her wrapper, she no even look me for face. I ask am, why pastor come? She say e come pray for her. But e don happen before, na the third time that month. I no be fool, I sabi wetin dey happen.

Since that day, I no dey comfortable for church. I dey watch that man like hawk. My wife say I dey overthink but I know wetin I see. Shey na so we see am, the man wey suppose dey lead us to God na im dey scatter our home?

❤️
💔
2
148

2 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In