🎖️Corporal

If your husband no send you birthday message, make you vex or make you forget?

My sister just dey cry because her husband no post anything for her birthday. The man buy cake, cook rice, even buy new wrapper. But e no post am for social media. She say e no love her again.

I bin just laugh. Since when social media post be the proof of love? This generation don spoil everything. My husband no even get Instagram. But e dey pay school fees, e dey carry load for market, e dey chop my food. Na him love.

Una wey dey vex for things like this, I beg una. Love no dey inside phone. E dey inside the person wey dey suffer with you.

Abi una think say na only public show matter?

❤️
💔
0
185

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In