🎖️Corporal

MTV VMAs drop Afrobeats category and we go just dey look?

Dem introduce am for 2023, we dey celebrate, we dey feel say na our time don reach. Now dem just drop am like say na ordinary rubbish.

I no understand. Burna Boy, Wizkid, Davido, Asake, all these artists dey carry our music go everywhere. But dem go just remove our category like that?

Oluwa o! Na so dem dey do us. Dem go use our own to get attention, then when e no dey convenient, dem go throway. E dey pain me. Our music no be small thing. Wetin man go do?

❤️
💔
1
182

1 Comment

Sign in to join the discussion

Sign In