Japa people dey suffer but nobody talk am. Na so e be.
3 months ago
My brother, I just dey observe something. Everywhere for this platform na japa this, japa that. Everybody dey run abroad like say Nigeria na prison. But nobody dey talk about the ones wey don go and dey suffer there. The ones wey dey wash plates for restaurant wey dem no go school for. The ones wey dey work double shift and still dey pay rent wey pass their salary.
I get cousin wey don stay London for seven years. Seven years! He still dey share apartment with three other Nigerians. He dey send money home small small but e no fit even buy car for there. Meanwhile im younger brother wey stay Lagos don build house for Aba. Who really win?
See ehn, I no dey talk say japa no get sense. But this idea say abroad na paradise, na lie. Grass no dey green for anywhere wey you no water am. The hustle for Lagos hard, but at least na your own people dey around you. When you fall, who go help you for foreign land?
Abeg which one better: suffer for Lagos with family and progress small small, or suffer for London with exchange rate wey dey finish you?
3 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In