💬 Discuss📍 Street Gist
🎖️CorporalAny woman wey no sabi cook, make she no marry my son
M
about 2 months ago
My first son bring one girl come house last month. Fine girl, correct English, good job for bank. I was happy small. Then she enter my kitchen...
I watch am as she dey chop onion like say na punishment. She no sabi blend pepper. She ask me where I keep salt. SALT! For my own kitchen wey I don cook for 30 years. My child, I just look her face. I no talk.
My sister say I too harsh. Say na 2026, men dey cook now. Na so? Then make her husband cook for her every day. But no come tell me say my son must chop indomie for the rest of him life because love is blind. Love no dey fill belle. So una tell me, if your son bring woman wey no fit boil rice, u go gree?
❤️
💔
2
173
2 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In