🎖️Corporal

Any woman wey no get her own money na slave to her husband

I

about 2 months ago

My husband no dey beat me. He no dey shout. But I know say if I no get my own money, I for dey beg for everything. Soap. Recharge card. Even pad. I dey beg for pad.

My own be say, any woman wey no get her own money na slave to her husband. No be curse. Na just fact. When you dey ask for transport money to go see your own mama, something dey die inside you small small.

I no talk say make woman no respect her husband o. But if you no fit buy one pure water with your own money, wetin you go do wen wahala come?

❤️
💔
0
153

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In