💬 Discuss📍 Street Gist
🎖️CorporalReno Omokri say N3,000 daily enough to live in Lagos. WHO BE THIS MAN?
C
about 2 months ago
N3,000 for one day? In which Lagos? Reno Omokri must be living in a different Nigeria, I swear.
My guy, from Yaba to my office, transport alone don finish N1,500. That one na just to go work and come back. I never buy food, I never pay light bill, I never even buy data. So make we calculate: transport N1,500, lunch N1,200, that one don pass N2,700 already. And I no get wife, no pikin, no rent for this calculation o.
If you dey live on N3,000 daily in Lagos, you be magician. Or you dey trek everywhere and chop garri three times. Abeg make una tell me, how much una dey spend for one day? Because this math no add up for my own pocket at all.

❤️
💔
0
195
0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In