🎖️Corporal

N3,000 a day for one person? Reno Omokri should come and manage my house for one week

M

about 2 months ago

Reno Omokri say average Nigerian fit live on N3,000 daily. I laugh tire wen I see am. My child, N3,000 na just one bag of rice for Mile 12, and that bag no go last one week for a family of four.

I dey sell foodstuff, so I know wetin market dey talk. Tomatoes, pepper, onion, garri, oil, gas to cook am. Before you finish, N3,000 don finish for ONE pot of soup. And person still need transport, data, and small thing for the children.

Maybe Reno Omokri dey chop once a day and waka go work. Who among una fit survive on N3,000 daily without begging somebody by Wednesday?

❤️
💔
6
171

6 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In