N5,000 Per Litre Fuel? Adewole Adebayo Don Drop Bombshell
about 2 months ago
SDP presidential candidate Adewole Adebayo just said fuel go hit N5,000 per litre if Tinubu win second term for 2027. The man talk am yesterday through him campaign spokesman Mark Adebayo, and the warning come after petrol don already jump near N1,500 for some filling stations.
Adebayo talk say na the economic policy direction dey cause am, especially the fuel subsidy removal and the way naira dey fall anyhow. He talk straight: "If the exchange rate hits N3,500 to $1 in the coming years, the landing cost of fuel alone will exceed N4,000." So if landing cost alone pass N4k, wetin pump price go be? Na that one make him warn say N5,000 per litre dey possible.
Make I ask una honest question. If fuel reach N5,000, how many of us go still drive? Bus fare from Mile 2 go reach N10k? Abeg, let's argue this one. Be honest, you believe say this thing fit happen or na politics dem dey play?

7 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In